💬 Discuss📍 Street Gist
🎖️CorporalKano people, why una dey put sugar inside masa? That thing na crime
A
about 1 month ago
I buy masa this morning for Sabon Gari, the woman don already pour sugar inside the batter. Wallahi I nearly return am. Masa na fermented rice cake, u put groundnut and pepper and onion. Sugar? For where?
My husband he laugh me say I too carry Kano matter for head. But this thing pain me. We grow up knowing masa with miyan taushe or just pepper and oil. Now every small girl wey open small joint dey add sugar cos she wan make am sweet for Southern customers. Kai. If u want sweet thing go buy puff puff, leave our masa alone.
Some people go say na modernization. I say na confusion. Tradition get reason why e be like that. So tell me, u dey put sugar inside ur masa or u dey chop am the correct way?

❤️
💔
17
174
17 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In