🗣️ Gist📍 Street Gist
🎖️Corporal

Bimbo Akintola talk about why she support politician, but na the fuel price cut wey catch my eye

C

about 1 month ago

Bimbo Akintola say Nigerians annoyed her so she support who she support. My sister, na your right o. But that one no put fuel inside my tank.

Wetin I see this morning na say Dangote refinery people dey talk fuel price cut. My guy, if that one happen, my Sunday viewing centre money go stretch. One litre fuel dey chop my pocket like Man United dey chop my heart every weekend.

If fuel price drop small, I go fit afford both the match and the suya after. Na that one I dey wait for. When e go land?

❤️
💔
5
187

5 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In