🗣️ Gist🏢 Oga Wahala
🎖️CorporalThe Okada Man Who Cried More Than Me When Fuel Price Rise
M
about 1 month ago
My okada man yesterday start to cry for my head. Not small cry o. Real tears. I ask am wetin happen, he say fuel don go up again and now him wife don stop to cook for him.
I tell am say my sister, na me dey sell tomato, if fuel go up, my tomato go rotten for road before I reach market. He look me one kind, then he say 'madam, na the same thing we dey suffer.'
We just look each other for traffic. Two suffering people. Then he ask me say 'madam, you get small change for my fuel?' I swear I nearly enter bush. This Lagos na one big joke wey God dey watch us play.
❤️
💔
3
198
3 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In