🔰Sergeant

US Firm Say Tinubu No Go Fit Rig 2027, Nigerians React

O

about 1 month ago

A US political advisory firm, Von Batten-Montague-York, don come out on their verified X handle on Thursday to say America will not allow President Bola Tinubu to rig the 2027 election. Dem even alleged say the government and Tinubu na bastion of corruption.

Dem talk say Tinubu appoint one person wey the US Department of Justice accuse say him embezzle billions from Nigeria treasury during a previous administration, and that person dey in charge of our budget now. The firm tweet say, "The US cannot afford to allow President Tinubu to rig the upcoming Nigerian election." Dem add say free and fair elections in Nigeria dey essential to protect US interests for Nigeria and the region.

But wait o, since when US dey determine who go win our election? Na dem send us democracy? Make we no deceive ourselves, the same America wey dey talk this one na the same one wey dey shake hand with all the leaders wey dey mess up their own country. Abeg, make we hear word. Am I the only one wey think say this one na just talk talk?

❤️
💔
0
154

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In