I found my husband's second wife in Ikeja, and she was pregnant
about 1 month ago
Two years ago I was sweeping my shop front when a woman call me from behind. She say she is pregnant for my husband. My husband wey dey drive danfo, the same man wey dey complain say fuel price dey swallow him profit. His own pikin inside another woman belle and I no know.
I no cry for market. I finish my sales that day. But when I reach house, I ask him. He no deny. He just say na mistake. Mistake wey don reach seven months. Oluwa o.
I pack my things go my sister house for Ikorodu. Three weeks. He beg. He say he go stop. But the pikin don dey come. That pikin no be mistake. Pikin na pikin. I look my four children face and I ask myself wetin I dey fight for. Sometimes I still dey wonder if I do the right thing by staying.
6 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In