Tinubu Says He's Correcting Past Mistakes, Nigerians Should Let Him Finish
about 1 month ago
President Bola Tinubu came out yesterday to tell Nigerians make dem allow am finish the work, say na him dey correct the mistakes of past administrations. He said this in a statement, asking for patience so he can complete wetin he start.
My problem with this talk no be say e wrong. Every president wey enter Aso Rock since 1999 don dey blame the person wey before am. Obasanjo blame Abacha. Yar'Adua blame Obasanjo. Jonathan blame Yar'Adua. Buhari blame Jonathan. Now Tinubu dey blame Buhari. So who go finish the work? Nobody.
I dey Kano, I sell cloth. When customer owe me money and I no deliver, I no go tell am say na the person wey sell before me spoil the market. I go just give am him cloth. If after three years petrol still dey kill us, naira still dey fall, and the only thing we hear na "allow me finish", then the work wey he dey finish, who e dey do am for? Be honest with me.

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In