Wike vs APC Govnors: Who Dey Play Who For 2027?
about 1 month ago
So APC govnors don open war against FCT Minister Nyesom Wike over this hin Rainbow Coalition movement, and honestly, I dey enjoy the confusion. Hope Uzodimma read out communique on September 14 say dem no dey support any arrangement wey go weaken APC, but Wike fire back say na Uzodimma dey chase Senate President seat for 2027, and fear say Rainbow Coalition senators no go back am.
Wike talk for TV say, "Take Soludo, Adeleke and Otti, shey e mean say dia parties no go present oda candidates? Dis tin dem dey tok no get any basis." See the man, PDP member serving APC government, still dey claim say na Tinubu second term him dey fight for. Denge Onoh come talk say Wike dey build autonomous political empire under APC nose, dey play 2027 numbers game to strip APC of legislative and state autonomy.
But make we no lie, if to say na your party, you no go fear? APC get super majority now, if Rainbow Coalition candidates win seats, dem fit decide who become principal officer, budget, even ministerial screening. So who really dey play who? Wike abi Uzodimma? Abeg make una talk true, who una think dey use who for this 2027 game?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In