🗣️ Gist📍 Street Gist
🎖️CorporalSpeed Darlington still dey carry Burna Boy matter for head, na wa o
C
about 1 month ago
Person wey still dey talk say "Enemies for life, I can never forgive Burna Boy" na Speed Darlington. I just see am on my phone this morning, I laugh tire.
My guy, when did Burna Boy offend this man reach this level? Every chance he get, na Burna name he go call. Wetin happen sef? Person wey you no dey see, you dey carry am for chest like this?
But make I talk truth, we all get that one person wey we no go ever forgive. Na just say some people dey do am for public, some dey do am quiet quiet.

❤️
💔
0
97
0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In