🎖️Corporal

Wife Wey Dey Check Husband Phone Every Night, Una Dey Mad Or Na Love?

M

about 1 month ago

My neighbor Funke dey check her husband phone every night. Every night. She go wait for am to sleep, then she go carry the phone go toilet. One day the man catch am. Chai.

Me I no dey check my late husband phone. Not because I no get sense. Because if I see wetin I no like, wetin I go do? I go pack my load for three children? For where? So I choose peace.

But this new generation women dem no gree. Dem say trust but verify. Verify wetin? If the man dey do nonsense, e go show for him face, not for phone. Abi I dey lie?

❤️
💔
0
37

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In