Nigerians Dey Waste Money On Wedding Rice But No Dey Do This One Thing
about 1 month ago
I dey my shop yesterday for Aba, one guy walk in, he wan buy iPhone 13. We talk price, ₦520,000. He say he go come back. Two hours later he come back, him face long. He say he just pay ₦450,000 for his sister wedding asoebi. Just asoebi o. Not the wedding. Just the cloth.
See my brother, I no dey against party. But make I break am down for you. That ₦450,000 inside a small business, even if na buying and selling phone cases, go turn to ₦900,000 in six months. That one go pay the sister school fees when the wedding don finish and everybody don go house. We dey celebrate one day and suffer ten years.
The wedding rice go finish. The small chops go finish. The DJ go collect him money and disappear. But the capital wey you put inside something wey dey move, that one no dey finish. If you wan know who truly love you, check who dey support your hustle, not who dey count how many gele you tie.
Abeg, if your sister wedding dey next month and dem ask you for ₦300,000 asoebi, wetin you go do?

10 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In