💬 Discuss🏥 Health
🎖️Corporal

One Woman Beg Me For Salt, I Gave Her. Wetin She Do Next Shock Me

Two weeks ago a woman come my shop for Agege. She say she need salt small, she go pay me next day. I look her face, she no dey lie. I give her the salt.

Next day she come back. She no bring money. She bring her sister wey dey sell beans. She say "my sister want buy provisions from you every week." Since that day, that woman sister don buy pass ₦40,000 from my shop.

Small salt. Big blessing. My mother always say help who you can help, you no know who God go use send your own helper. Abi na lie?

❤️
💔
1
0

1 Comment

Sign in to join the discussion

Sign In