My guy carry date go viewing centre, the babe still help am shout GOAL
30 days ago
My guy call me yesterday say make I come viewing centre with am and e babe. I ask am say na which kind date be that. He say the babe love football pass am, so na there dem go bond.
We reach there, the babe no even sit down. Every time the ball near box she dey stand up, she dey shout, she dey abuse referee. My guy just dey look her like person wey win lottery. The babe buy kpekere and zobo for all of us sef.
Small time she begin explain offside to one oga wey dey argue. The whole viewing centre quiet. My guy lean close to me, he say 'Chidi, na this one I go marry.' Two weeks later dem don do introduction.
So na viewing centre now be the new matchmaking spot? Abi make I start to charge gate fee for love?

0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In