🎖️Corporal

My daughter say she wan marry the boy wey no get work. I told her NO.

Funke just finish WAEC and now she dey tell me say she wan marry one boy wey she meet for lesson. The boy no get work. No handwork. Nothing. Just fine face and sweet mouth.

I ask her, wetin una go chop? Love? She say the boy dey hustle small. I say hustle where? Na so my sister marry one fine boy wey no get plan. Today she dey sell pure water for junction to feed three pikin.

I no say make she no love. But love no dey pay rent. Love no dey buy garri. Abeg, make una tell me if I dey wrong to refuse.

❤️
💔
1
0

1 Comment

Sign in to join the discussion

Sign In