🗣️ Gist🏥 Health
🎖️Corporal

The Day My Body Shut Down Inside Agege Market

I was arranging my provisions that morning when the ground start to move under my feet. I hold the table, I tell myself say na small thing. Next thing, my legs just fold like say dem cut off.

Oluwa o, I wake up on the floor with market women fanning me with nylon bag. My blood pressure was high. The doctor ask me when last I rest. I couldn't answer. Every day na market by 6am, close by 8pm, then cook, then check Tunde's work, then sleep by 1am.

I dey sell medicine to people but I no dey take my own. E dey pain me to admit say I was killing myself slowly. Now I sit down small when my body talk. Wetin man go do? Money must come, but who go sell am if I fall down?

❤️
💔
0
132

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In