🎖️Corporal

Pastor Abel Damina says first fruit money no dey Bible. My question na this

I dey close my shop yesterday evening wen my neighbor shout say Pastor Abel Damina don talk say there is nothing like first fruit money. She play the video loud loud for me. The man say Christians should stop paying it.

My own be say, I no go argue Bible with anybody. But I remember one January, my daughter Funke was to resume school and I had only small money. My pastor say bring first fruit or the year go hard for you. I brought am. That same week, my supplier dash me two cartons of soap wey I never order. Coincidence? I no know.

So wen person say make we stop, wetin I go do with the fear wey don dey my body since?

❤️
💔
0
189

0 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In