Any woman wey no sabi cook for this Kano, I no dey marry her. No be by love.
15 days ago
My brother come meet me last week, say him wan marry this girl but she no sabi cook. She fine, she get good job for bank, but she no sabi cook. Wallahi I tell am make him no waste him money.
I know say some people go talk say I old fashion. But make we reason am. If you marry woman wey no sabi cook, every night na either you buy food outside or you cook by yourself. And for this economy? With dollar at ₦1,360? You wan dey buy shawarma every night? That one no be marriage, na business partnership.
My own wife, before I marry her, I test her with miyan kuka. She pass. Till today, I no dey regret. If she no sabi cook, I for no marry her, no matter how fine she be. So my question be this: if your woman no sabi cook at all, you go still marry her?
0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In