💬 Discuss📍 Street Gist
🎖️CorporalAny man wey no fit buy him babe small chops at 10pm no deserve her
K
13 days ago
I dey tell you, if you dey date woman wey fine reach that one, you must show say you sabi spend small. Not say you go buy her Benz, but at least when she say she dey hungry at 10pm, you no go tell her say make she drink water.
My guy, I see one guy last week for Aba, him girl call am say she want small chops, the guy come dey explain budget for her. Chai! That girl face just change. If you no fit handle small chops, how you go handle her birthday? How you go handle her mama hospital bill?
Me I no dey support nonsense, but if you love her, show am with your pocket small. No be every time you go dey talk grammar. Wetin you dey do when your babe say she want something at night?
❤️
💔
6
165
6 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In