🗣️ Gist📍 Street Gist
🎖️Corporal

Odumeje say some pastors dey fake miracle, I laugh wan die

I dey grind pepper for my small corner wen my neighbor Funke rush come meet me. She say Odumeje don talk am. Say some pastors dey stage fake miracle. I just look her. Odumeje? The same man wey dey spray people water and shout citadel?

My own be say, if na him talk am, e be like thief wey dey warn anoda thief. But I no go lie, e make me remember one church for Agege. Pastor call person wey dey limp come front, pray for am, the person waka well. Next Sunday, same person dey limp again. Na so the miracle dey expire?

Abeg, make una no let me talk too much. But I wan ask una one thing: if pastor dey fake miracle, wetin the person wey dey pretend go tell God on judgement day?

❤️
💔
4
178

4 Comments

Sign in to join the discussion

Sign In