🗣️ Gist🙋 Ask a Question
🎖️CorporalPastor wey dey fake miracle, na him dey sell anointing water for ₦5,000
M
13 days ago
Odumeje talk am say some pastors dey stage fake miracle. I no surprise. My sister bin buy one bottle of anointing water for ₦5,000 from one church for Egbeda. She say pastor tell her na water from Jordan. Na pure water dem just pour inside bottle.
I no dey judge anybody faith but this thing wey pastors dey do for money dey pain me. Real miracle no dey cost ₦5,000. My mother use to say if God heal you, na free. If man heal you, na him pocket you dey feed.
My question be this: if the miracle is fake, na the pastor go answer for judgment day or the person wey buy the water?
❤️
💔
0
196
0 Comments
Sign in to join the discussion
Sign In